Tinubu grant 'protection' to Guinea-Bissau presidential candidate inside Nigerian embassy afta coup

Wia dis foto come from, Samba BALDE / AFP via Getty Images)
Nigeria President, Bola Tinubu don approve protection and security for Fernando Dias Da Costa, Guinea Bissau presidential candidate for di November, 2025 presidential election, for inside di Nigerian Embassy for Guinea Bissau.
Inside one letter wey dey signed by Nigeria Minister of Foreign Affairs, Yusuf Tuggar and addressed to di President of di Economic Community of West African States, Ecowas, Omar Touray, oga Tugar say President Tinubu approve di "provision and of protection and security for di premises of di Nigerian Embassy inside Guinea-Bissau."
Di letter also say na President Tinubu decision na "a proactive measure to ensure di safety of Mr Da Costa in response to imminent threat to im life."
Dis dey come afta military takeova power for di kontri through coup as citizens dey wait for di outcome of di presidential election.
President Tinubu tok say di move also show say Nigeria stand gidigba to "safeguard di democratic aspirations and di sovereign will of di pipo of Guinea-Bissau.
Im also ask di Ecowas Stabilization Support Mission for Guinea-Bissau to give Da Costa protection and security as im dey for di premises of di Nigerian Embassy.
Di Incumbent President Umaro Sissoco Embalo bin dey compete against top challenger Fernando Dias for di presidential election wey hapun for November, 23, 2025.
Dis two pipo dey claim say na dem win di election for di first round wey hapun earlier dis week.
End of Di one wey oda users dey read well well
Fernando Dias, wey be President Umaro Sissoco main rival dey contest di results.
Dias get di backing of di former Prime Minister Domingos Simoes Pereira wey dem bar from running wit di main opposition party, di PAIGC.
PAIGC na di party wey lead to Guinea-Bissau independence, and di Pai Terra Ranka coalition, wey e lead bin bring around ten political parties togeda.
Di electoral commission bin promise to announce di final election results by Thursday, afta dem cut warning give voters, candidates, political parties, electoral coalitions, and di media against announcing any results.
As residents bin dey wait for di election results, some armed men arrest Guinea-Bissau President Umaro Sissoco Embaló for wetin resemble coup for di capital Bissau.
Na three days afta di presidential election, wia dem disqualify im main opposition e hapun.
One group of military officers bin tok say na dem seize control of Guinea-Bissau, afta gunshots bin dey ring for di capital city Bissau.
Goment sources tell BBC say dem bin detain Embaló.
Army officers give address for state TV, say dem don form "di High Military Command for di Restoration of Order" and dem go dey in charge of di West African nation until further notice.
Embalo bin take part for di 23 November 2025 presidential and legislative elections wia e cast im vote for Nema 1 for Gabu area of Guinea-Bissau.
Guinea-Bissau get population of about 2.2 million and na one of di West Africa kontris wey dey part of di Portuguese Empire for centuries bifor.
'Foul play'
Meanwhile former president of Nigeria, Goodluck Jonathan wey be one of di observers for di election bin dey trapped for Bissau sake of di military takeova wey lead to curfew.
Im later land for Nigeria wit di presidential jet of Ivory Coast and im tok say 'dem must announce winner of Guinea-Bissau presidential election result'
Oga Jonathan say e dey strange say di sitting president go announce coup by imsef for im own kontri, allegation wey Embalo neva deny.
E say Guinea-Bissau President Embalo bin dey address media while di coup bin dey go on, but no be so coup be.
"Wetin hapun for Guinea-Bissau, I no go call am coup, no be coup. I fit describe am as ceremonial coup becos di president, Embalo bin announce di coup."
"Later di military man come up to address di world say dem dey in-charge, but Embalo don alreadi announce bifor and e dey strange.
"While di coup dey take place, Embalo dey use im phone to address media organisations across di world, say dem don arrest am."
Oga Jonathan say as an experienced Nigerian leader and Ecowas mediator wey dey close to 70 years old, im sabi how dem dey keep head of state wen coup hapun, but di one wey happun for Guinea-Bissau no be am.
"Military coup no go takeova govment and di sitting president wey dem overthrow go dey allowed to dey address press conferences or dey announce say dem don arrest am."
"Wetin hapun for Guinea-Bissau dey more disturbing to me wey believe for democracy, I feel more pain.
E describe di situation for Guinea-Bissau say e be like say dem dey go back to di dark days of Guinea-Bissau wia military fit do anyhow and 'e dey unacceptable.'











