Senegal beat Morocco to win Afcon 2025 afta last minute drama

Pape Gueye afta im scre di Afcon winning goal

Wia dis foto come from, Torbjorn Tande/DeFodi Images/DeFodi via Getty Images

Read am in 8 mins

Senegal don win dia second Afcon title afta dem beat host Morocco for extra time of di Afcon 2025 finals.

Dis na as Pape Gueye goal for di beginning of extra time seal di deal for dme afta Morocco bin miss dia penalty kick for di last minutes of normal time.

Di first time wey dem win, dem sama Egypt for Yaounde on penalty shootout to carry di title for 2022.

Dis match hot as both teams bin miss out on penalties, bin get ogbonge shots and at some point Senagal team vex sotay dme start to dey comot pitch, na only Sadio Mane fit calm dme down las-las.

Extra Time

Hakimi and Sadio Mane as dem dey play ball for different fields wey dme come crop dia pictures togeda wit Hakimi as e dey rep Morocco andMane as e dey rep Senegal

Wia dis foto come from, Ryan Pierse/Getty Images

Senegal don score ogbonge goal for Extra Time wit Pape Gueye wey dribble pass Morocco captain Achraf Hakim and sama shot.

99 mins - Brahim Diaz wey miss dying minute penalty don dey substituted for Ilias Akhomach. And Noussair Mazraoui don comot for Hamza Igamane.

100 mins - Five Minutes remain for extra time first hald Edouard Mendy dive to save Youssef En-Nesyri header.

103 mins- Hamza Igamane don pause game as e twist im knee.

104 mins - Youssef En-Nesyri collect low cross to shoot am wit diving header for wide.

105 mins - Omo di way 17 year old Ibrahim Mbaye just dribble three players bifor Hakimi block am sha.

105 mins - One minute dey added to di end of di first half of extra time.

105+1 mins - Hakimi reach byline but im cross no reach any of im team mates.

105+2 mins - HALF TIME OF EXTRA TIME DON REACH. E remain 1 minutes for di Afcon finals.

106 mins - Substitution for Senalgal as El Hadji Malick Diouf wey n score im own penalty don comot for Ismail Jakobs.

107 mins - Morocco don win corner kick

108 mins - Ilias Akhomach sama beta sht but Nayef Aguerd head am to di bar.

109 mins - Dem don turn am to gbas-gbos. Hakimi latest cross dem don clear am.

110 mins - Ilias Akhomach curve free kick give Mendy.

112 mins - Senegal don miss goal as Cherif Ndiaye see im shot enta Bounou hand.

114 mins - Mamadou Sarr from Senegal don dey booked for tactical foul

115 mins - Na five minutes remain for dis dramatic final

116 mins - Goalscorer Pape Gueye dey ginger for anoda goal as im shoot from 35 yards but im shot enta di Morocco keeper hand.

117 mins - E don dey red for Morocco. Evrione don dey behind di ball for Senegal.

119 mins - Dem don tackle Hakimi. Senegal keeper Edouard Mendy don catch cross

120 mins - Injury time of three minutes wey dey added

120+1 mins - Senegal throw right for di corner flag

120+2 mins - Anoda throw in.

Second Half

47 mins - Senegal enta second half wit beta possession.

49 mins - And now Morocco dey move di ball for midfield, nobodi don shoot dia shot. Everywia just dey hot!

50 mins - Back to back Morocco corner kicks but dem clear dem.

52 mins - Abde Ezzalzouli win im side free kick but Achraf Hakimi play am enta two men.

57 mins - Sadio Mane don gbab space for left and den dem block im cross bit dem push Lamine Camara comot.

59 mins - Massive ckance for Ayoub El Kaab wey im miss afta Bilal El Khannouss pass am beta crossing.

60 mins - Cross for Nicolas Jackson don kick am comot.

62 mins - Morocco don move front again! Diaz give ball to El Kaabi wey shoot biut dem block am. Abde come play wide rebound.

65 mins - Hakimi cross into box don dey sliced to give corner to Moussa Niakhate.

67 mins - Eeeeeiiiii Neil El Aynaoui and El Hadji Malick Diouf don nack dia heads togeda as dem dey find ball. Six!! Seven!!!

68 mins - El Aynaoui bad pass di oda one as dem dey prep substitute!

70 mins - dem neva still start match again. Di plan now na to wrap El Aynaoui head wit bandage to continue.

74 mins - match don start again. Neil El Aynaoui don stand and noaw dey side as Morocco restart match wit corner kick.

76 mins - Hakimi work but dem clear and and Bilal El Khannouss don come back field afta eight minutes delay.

78 mins - Senegal dey change three players. Dem dey bring Abdoulaye Seck, Ismaila Sarr, and teenager Ibrahim Mbaye to replace Antoine Mendy, Lamine Camara and Iliman Ndiaye.

79 mins - Morocco don run dia own subs too. Dem comot Bilal El Khannouss and Ayoub El Kaabi for Oussama Targhalline and Youssef En-Nesyri.

80 mins - Morocco get corner Abde Ezzalzouli just carry give Senegal keeper for hand.

85 mins - Brahim Diaz curve ball dey blcked.

87 mins - Substion of Adam Masina for Morocco dey replaced by Jawad El Yamiq.

89 mins - eenage substitute Ibrahim Mbaye play beta but Morocco keeper Yassine Bounou match am aura for aura.

90 mins - Eight minutes added time

90+5 mins - Morocco corner dey headed out.

90+7 mins - VAR to see weda dem go fit give Morocco penalty

90+8 mins - Dem don give Morocco penalty for di dying minute

Ismaïla Sarr and El Hadji Malick Diouf don gbab yellow card

100 mins - Senegal no gree comot penalty area o! E don red!!!

90+12 - Senegal manager don ask im team to comot pitch.

90+14 mins - Senegal dey waka go dia bench, Morocco players dey beg make dem come back play ball.

90+18 mins - Sadio Mane no gree waka go dressing room wit some of im teammates as now e don dey call dem back.

90+20 mins - Sadi Mane go tunnel go bring im teammates back as Édouard Mendy don dey go goalpost for di penalty only to collect yellow card.

90+23 mins - Ma Diaz go take di penalty

90+23 mins - Saved Penalty!!! Afta evri evri!!!!

90+24 mins - Like dat full time don reach we enta extra time

First Half

2 mins - Achraf Hakimi win free-kick. Dem dey boo Senegal wen dem dey pass ball

3 mins - Ball wey dem pass go backwards pass di Senegal keeper Edouard Mendy legs put defender comot am bifor e enta.

4 mins - Achraf Hakimi run forward only to jam im team mates.

5 mins - Sadio Mane win early corner for im side afta dem block im cross

6 mins - Almost 1-0 as Senegal corner kick alost enta as Moroccan keeper Yassine Bounou first miss am bifor im adjust block ball wit chest

8 mins - na Senegal dey push pass for dis time as Nicolas Jackson push, Noussair Mazraoui bounce am comot.

10 mins - Moroccan Abde Ezzalzouli see im chance dey blocked my Malik Diouf.

12 mins - Morocco don get goal kick.

14 mins - Morocco don dey do doinds as Ismael Saibari move from midfield as gap open for am at edge of bo only for am to use left leg kick am troway.

16 mins - Iliman Ndiaye dribble Nicolas Jackson only for Antoine Mendy do beta defending work for dia to make am goal kick

20 mins - All Senegal attacks dey pass through Sadio Mane. E don enta midfield to try make sometin happun.

22 mins - Morocco find opening and Ismael Saibari enta one on one until e give di ball to di keeper but e dey wide. Howeva e still dey offside sha.

24 mins -Lamine Camara don gbab di first yellow card of di game afta e dive for di halfway line and enta Neil El Aynaoui.

27 mins - Nicolas Jackson don clear di ball and Sadio Mane don win wide free kick.

28 mins - Lamine Camara go want that free kick back. E smash im cross ova evribodi and go for goal kick.

30 mins - Yassine Bounbou do beta keeping as im head ball wey bin wan go Sadio Mane

34 mins - Morocco no fit use di wide free kick do beta tin and ball don go back to Senegal. Malick Diouf dribble two players to enta midfield.

38 mins - Ahhhh beta save!!!! Nicolas Jackson bin get ogbonge ball give Iliman Ndiayee wey enta one on one wit keeper.

But e no make am as keeper Yassine Bounou quick comot im line and manage comot di ball wit kick.

41 mins - Morocco almost open scoring afta Ismael Saibari spin from defender and sama ogbonge ball. Even though Morocco defender Nayef Aguerd dey free for middle.

45 mins - Four minutes dey added to di end of di first half! Senegal move forward till dem tackle Sadio Mane for di box. Senegal don get corner

45+2 mins - Morocco head Senegal corner comot.

45+2 mins - Morocco don lose possession for dangerous area, all Lamine Camara suppose do na play in Sadio Mane but guy shoot am nad dem block am. Chai!!!

45+4 mins - HALF TIME DON REACH!!!

Line ups

Hakimi and Sadio Mane as dem dey play ball for different fields wey dme come crop dia pictures togeda wit Hakimi as e dey rep Morocco andMane as e dey rep Senegal

Wia dis foto come from, Ryan Pierse/Getty Images

From di team side dem don least di 11 players wey go play for id AFCOn trophy

For Senegal na: Edouard Mendy, Antoine Mendy, Niakhate, El Hadji Malick Diouf, Camara, Idrissa Gueye, Iliman Nadiaye, Pape Gueye, Jackson, Mane

For Morocco na: Bounou, Hakimi, Aguerd, Masina, Mazraoui, Ezzalzouli, El Aynaoui, Saibari, El Khannouss, El Kaabi, Diaz

Dis no go be di first big moment for di Morocco team wey dey headed by Walid Regragui in recent years.

Dis na becos Morooco becom di first kontri from Africa wey go reach World Cup semi-finals wey dem do for 2022.

Dem also jump enta 11 for di world rankings even pass Italy sef.

But dis neva change anytin for dia track record for di African stage as dia only Afcon tilte dem win am for 1976.

In fact dis na di first time wey dem even smell di finals since 2004 wey Ragragui still dey play for di team sef, but dem still loose to Tunisia