Second Epstein victim claim say dem bin send her to UK for sex wit Andrew, lawyer tok

Andrew Mountbatten-Windsor

Wia dis foto come from, Aaron Chown - Pool/Getty Images

Read am in 9 mins

Anoda woman dey allege say Jeffrey Epstein bin send her to di UK for one sexual encounter wit Andrew Mountbatten-Windsor, na wetin her lawyer tell di BBC.

Di encounter allegedly occur for di former prince residence, Royal Lodge, for 2010.

Di woman, wey no be British, bin dey in her 20s dat time.

Brad Edwards from di US firm Edwards Henderson wey be di woman lawyer say afta spending di night wit Andrew, she say dem bin carry her waka around Buckingham Palace and tea.

"We dey tok about at least one woman wey Jeffrey Epstein bin send ova to Prince Andrew. And she bin even get, afta one night wit Prince Andrew, a tour of Buckingham Palace," di lawyer tok.

BBC News don ask Andrew Mountbatten-Windsor for comment, but so far im neva respond to dis accusations.

Na routine for Buckingham Palace to record di names of tour guests but e neva dey possible for di BBC to corroborate di woman visit witout revealing her identity.

Di woman account of spending di night for Andrew home na di first time wey any Epstein survivor dey allege say sexual encounter bin happun for di royal residence.

Edwards dey represent more dan 200 Epstein survivors worldwide, and im bin represent Virginia Giuffre, wey bin allege say dem bin bring her to London to have sex wit di former prince for 2001 wen she bin dey 17.

Giuffre say dem bin force her to have sex wit Andrew two more times between 2001 and 2002 - once for New York and anoda one for Epstein private Caribbean island.

Dem bin convict Epstein for 2008 sake of say im dey beg for sex from a 14-year-old girl for Florida and im bin complete im sentence for July 2010.

Di lawyer, wey dey based for Florida, tell di BBC say communications between im client and di former prince bifor di encounter wia she say she bin spend di night wit am dey plenti.

Edwards say im bin dey in contact wit "certain legal counsel" of di former prince for di United States, but say " e be like say Andrew bin disconnect from im lawyers".

Communications bin stop afta King Charles formally remove Andrew "style, title and honours", im tok. Dem bin strip Andrew of im royal titles for October last year, sake of di publication of Giuffre posthumous memoir. Dem bin also announce say im go comot from di Royal Lodge for di Windsor estate, wey don be im home since 2004.

For di statement wey bin announce di removal of di former prince titles, di Palace say: "Dis censures dey necessary, notwithstanding di fact say im continue to deny di allegations against am."

Edwards say di stripping of Andrew titles allow di former prince to maintain say im no get money and no ability to provide compensation, and to "allow dis women to just suffer".

"So di idea say di Royal Family so far care about di victims, and bin wan make tins right - wetin dem do by simply stripping Prince Andrew of im titles and notin more, don get di exact opposite effect of wetin dem claim say dem dey try to do." im tok.

One BBC investigation find out say Epstein bin traffic plenti women into di UK through commercial flights and im private jets.

Buckingham Palace for October say "dia majesties wish to make clear say dia thoughts and utmost sympathies dey wit di victims and survivors of any and all forms of abuse".

Di lawyer say im dey consider filing a civil lawsuit on di woman behalf against di former prince.

Virginia Giuffre bin file civil lawsuit for di US against Andrew for 2021 - dem settle di case for February 2022 for an estimated £12m. She kpai hersef last year.

Andrew dey always deny Giuffre claim.

Fotos wey dem release for Epstein files appear to show Andrew dey kneel ova female

Man wey get grey-hair wear white polo shirt and blue jeans, im look directly inside di camera. Im dey on all fours directly over one unidentified female who dey lay down for floor.

Wia dis foto come from, US Department of Justice

Wetin we call dis foto, Andrew Mountbatten-Windsor dey always deny any wrongdoing

Earlier on Friday, foto wey appear to show Andrew Mountbatten-Windsor as e kneel ova one woman wey dey lie down for ground na part of di latest batch of Epstein files wey di US Department of Justice release.

Two of di fotos show am dey touch di pesin wey wear clothes, for her stomach. Dem no identify di woman. Anoda image show am as e dey look directly into di camera.

No context dey supplied for di fotos and e no dey clear wen and wia dem take di fotos.

Di images dey likely to put further pressure on Mountbatten-Windsor, wey dey face years of scrutiny ova im past friendship wit Jeffrey Epstein. BBC News don approach Mountbatten-Windsor for comment. Im don deny any wrongdoing many times.

Separate emails wey dem release on Friday also suggest say di late sex offender Epstein bin invite Mountbatten-Windsor to get dinner wit one 26-year-old Russian woman. Na for August 2010 dem exchange di messages, two years afta di billionaire Epstein plead guilty to soliciting a minor.

Di newly released email exchanges and fotos form part of more dan three million pages of documents and 180,000 images wey dem bring out for public on Friday.

Oda pictures wey dem release show images of unidentified women wey dem block dia faces, and wetin appear to be luxury apartments, hotel rooms, and one villa wit swimming pool.

Man wey wear white polo shirt and faded blue jeans stand ova one female wey wear black trousers and white blouse. her face dey covered wit black rectangle. di man dey touch her belle. She lie down for ground for one large room, wey resemble dining room or hallway.

Wia dis foto come from, US Department of Justice

Wetin we call dis foto, Di unidentified female wear cloth wey cova all her bodi for di foto
Man wey kneel over one female wey lie for ground . Her face dey covered by wit black rectangle. She wear black trousers and white blouse, and she raise her left arm. Di man dey touch her midriff on her side.

Wia dis foto come from, US Department of Justice

Wetin we call dis foto, For one of di fotos, her hand dey raised as Andrew dey touch her side

Di emails between Epstein and one account named "The Duke" on 11 and 12 August 2010 suggest say di American bin wan to introduce "A" to one 26-year-old Russian woman, wey Epstein suggest say im "fit enjoy dinner wit".

Im tok say di woman go dey for London for August 2010.

"Di Duke" reply say im go dey for Geneva "until di morning of di 22nd but im go dey happy to see her" bifor im ask: "She go bring message from you? Please give her my contact details to get in touch."

Im ask Epstein weda "any oda information dey wey you know about her wey fit dey useful to know?"

Epstein reply say "she [dey] 26, Russian, clevere [sic] beautiful, trustworthy and yes she get your email".

Dem bin convict Epstein for 2008 of soliciting sex from one 14-year-old girl for Florida and im bin complete im sentence for July 2010, one month bifor di email exchange. Di BBC neva fit independently verify di emails.

Also among di latest batch of documents na anoda email exchange wit date, 27 September 2010 between Epstein and di account titled "The Duke".

Epstein write say im dey London, im add: "Which time you go like me and [e dey blocked], we go also need/get private time".

"The Duke" reply: "I just dey comot from Scotland I suppose dey down by 1800. I go ring you wen I get down if you fit give me a number to ring. Alternatively we fit get dinner for Buckingham Palace and lots of privacy. A".

Epstein reply: "bp pleease [sic]."

Di emails no indicate any wrongdoing. Di BBC don contact Mountbatten-Windsor for response.

Anoda document, from 2020, na formal request for assistance from US authorities wey ask to interview di former prince as dem bin believe say "Prince Andrew fit be witness to and/or participate for certain events of relevance to di ongoing investigation".

Dem tok say documentary evidence "don reveal information wey suggest say Prince Andrew bin know say Maxwell bin recruit females to engage in sex acts wit Epstein and oda men" and "evidence dey say Prince Andrew bin engage in sexual conduct wey involve one of Epstein victims".

Di letter also say: "Presently, Prince Andrew no be di target of di investigation, and US authorities neva, up till date, gada evidence say im don commit any crime under US law."

Mountbatten-Windsor don repeatedly deny all wrongdoing in relation to Epstein, and im tok say im no "see, witness or suspect any behaviour of di sort wey bin subsequently lead to im arrest and conviction".

Im bin don face allegations, wey im don repeatedly deny, say im bin sexually assault Virginia Giuffre as a teenager afta she tok say Epstein bin traffic her.

Im bin pay financial settlement to Giuffre, wey im claim say im neva even meet, to settle di civil sexual assault claim for 2022.

Sarah Ferguson. Photo: April 2025

Wia dis foto come from, EPA-EFE/REX/Shutterstock

Wetin we call dis foto, Sarah Ferguson, Mountbatten-Windsor former wife, neva publicly comment on di latest release of emails

Some emails wey appear to dey been between Sarah Ferguson and Epstein also dey for di latest release.

One email wit date 4 April 2009 - signed "Love, Sarah, The red Head.!!" - read: "Hello Jeffrey. I dey land for Palm Beach in a couple of hours. Any chance dey on my quick layover, wey I fit get for quick cup of tea..."

Di email continue to discuss ideas for Ferguson company, Mother's Army. Di former Duchess of York refer to Epstein as "My dear spectacular and special friend Jeffrey. You be legend, and I dey so proud of you."

Di financier bin still dey under house arrest wen dem bin send di email exchange.

For anoda exchange for August 2009, Ferguson send emails to Epstein again to discuss "my Sarah Ferguson Brand" and tank di billionaire "for being di brother I don always wish for".

Di emails no indicate any wrongdoing. Di BBC don contact Ferguson for response.

More dan 2,000 videos and 180,000 images dey included for di latest batch. Dia release dey comes six weeks afta one deadline mandated law wey President Donald Trump sign.

Many of di documents dey heavily blocked wit some files wey show pages wey dey entirely blacked-out.