'We go investigate to know know weda na AI' - Military tok about wanted Ipob fighter 'Gentle De Yahoo' wey re-appear for video

Wia dis foto come from, UGC/Nigeria Defence Headquarters
Di Nigeria Defence Headquarters don react to new videos of one separatist fighter for di southeast region, Ifeanyi Eze Okorienta, wey pipo know as 'Gentle De Yahoo', who dem bin tok say dem bin arrest for counter-insurgency operations for October 2025.
Videos of Gentle De Yahoo start to spread on top social media on Thursday as e dey tok say news of im death na lie.
For di video wey e shoot for inside bush, di insurgent tok say im bin dey down wit sickness bicos im and some of im men bin chop poison and dem almost die, but dem carry am go one local healer for Cross River State and dat na wia dem revive am.
Commenting on di video dis Friday, Mike Onoja, di Director of Media Operations for di Defence Headquarters say di army neva get official report about am, but dem go investigate.
"However, wetin I fit tok be say for dis current dispensation of AI (Artificial Intelligence), e dey possible to create anytin just to distablilise and cause panic witin di society," oga Onoja tok.
"Notwitstanding, as you don tok am now, we. go initiate necessary action wit di relevant security agencies to confam weda na true say e don come bak, and den we go take necessary action to contain any individual or group wey try to threaten security and safety," e add.
Rememba say for September 2025, for dia period press briefing, di defence toktok pesin dat time Markus Kangye bin narrate how di troops of Operation Udoka for di southeast region of di kontri take arrest Gentle De Yahoo betwin 8th to 13th October.
Bifor dat confirmation, tori bin don dey spread say di army don kill Gentle and im boys, who security operatives don blame for many of di violent crimes wey dey hapun for di Owerri and Okigwe axis of Imo State.
But for dat press briefing on 16 October, 2025, oga Kangye tok say: "Troops (of Operation Udoka) bin conduct offensive operations and arrest suspected Ipob/ESN terrorist commander identified as Gentle, wey bin dey on di wanted list along wit eight oda criminals along Owerri West and Mbaitoli Local Govment Areas of Imo State, as well as Izzi and Ohaukwu Local Govment Areas of Ebonyi State."
Howeva, for di new video wey don go viral on top social media, di separatist fighter mock di Nigeria army and security forces as e tok say di news of im death na fake.
"I know say many fit believe, and many fit no believe, many fit say na AI, but dis na me, Gentle De Yahoo, no be AI, we no dey two," e boast as e touch and pull im bear-bear to convince pipo say true-true di clip no be AI.
Who be Gentle De Yahoo?
Ifeanyi Eze Okorienta na di commander of di Biafra Liberation Army, one of di plenty groups of separatist fighters for di southeast region of Nigeria wey claim say dem dey fight for di independence of Biafra and to pursue killere herdsmen comot from di region.
Di group pledge allegiance to Nnamdi Kanu, leader of di Indigenous People of Biafra (Ipob), who one court for Nigeria don sentence to life imprisonment sake of terrorism.
Also, di BLA as dem call demself dey also get funds from Simon Ekpa, one Finnish-Nigerian man wey don chop six years in prison for Finland afta court for di kontri find am guilty of financing terrorism.
Plenty times e don appear for videos wia e go carry machine gun and wear chain bullets for body, and dey boast, dey dare Nigerian soldiers to come catch am.
For some of im videos e go threaten communities and anybodi wey be 'sabo', di name wey di separatist fighters dey call anybodi wey no gree wit dia ideology.
Di Nigeria police blame groups like di BLA for for di killing of security operatives and destroying of govment buildings across di southeast.
Na dis armed groups, according to security agents, also dey responsible for di Monday sit-at-home situation for di region, as na dem dey put fear for pipo body to make dem stay for house on Mondays to protest di arrest of Nnamdi Kanu.









