E good for heart, dey help brain function and oda health benefits of banana

Wia dis foto come from, Caterina Oltean via Getty Images
- Author, Abubakar Maccido
- Role, Reporter
- Reporting from, Kano
- Read am in 3 mins
Banana na tropical fruit wey get soft, creamy flesh and sweet taste wen e don ripe. Wen e neva ripe, e dey get small starch and tangy flavour.
According to Dietitian Aisha Bala Ahmad from Kano, northwest Nigeria, banana na one of di oldest fruits wey pipo don dey cultivate for dis world becos e sweet naturally, easy to carry, and full of nutrients - banana don turn one of di most eaten fruits globally.
Dietitian Ahmad tell BBC News Pidgin say, "Banana get small amount of iron and folate wey dey help form red blood cells."
She add say banana dey easy to digest, so e good for evribodi from small pikin to old persin.
Health benefits of banana
- E dey give quick energy: Sake of di carbohydrate wey e get, banana dey provide fast energy bifor or afta exercise.
- E good for heart health: Di potassium inside banana dey help control blood pressure and reduce hypertension risk.
- E dey support digestion: Di fibre wey e get dey help make persin dey poop well and stop constipation.
- E dey help mood and brain function: Vitamin B6 and tryptophan dey help bodi produce serotonin, wey dey reduce stress and make mood beta.
- E dey prevent muscle cramp: Di potassium inside banana dey help muscles relax and stop cramping.
- E dey improve gut health: Green (unripe) banana get resistant starch wey dey feed good bacteria for belle.
- E dey help prevent anaemia: Sake of di iron and folate wey e get, banana dey support formation of red blood cells.
Nutritional Content (for evri 100g banana)
- Energy: 89 kcal
- Carbohydrates: 22.8 g
- Sugars: 12.2 g
- Protein: 1.1 g
- Fat: 0.3 g
- Dietary Fiber: 2.6 g
- Potassium: 358 mg
- Magnesium: 27 mg
- Vitamin C: 8.7 mg
- Vitamin B6: 0.4 mg
- Folate: 20g
Implications/side effects
Overripe banana: E get high sugar content, so pipo wey get diabetes gatz watch how dem dey eat am.
Allergy or latex sensitivity: Some pipo wey dey allergic to latex fit react to banana too.
Too much banana fit cause high potassium especially for pipo wey get kidney wahala.









